正在加载视频...

视频加载失败

Asantehene no Dey fix Kumasi, zero development, old building, poor roads Guess who water carry am away

343,580 次观看 • 3 个月前 •via X (Twitter)

0 条评论

暂无评论

原始帖子的评论将显示在这里

相关视频

Una remember Oputa Panel Dat my papa show wey almost wan dey as popular like The CharlyBoy Show. I be Charly Boy Area fada I don see plenty useless film for this country Na the same cassette dem dey rewind Colonel open mouth Truth close eye Call Yoruba name Igbo Just to repaint fear Just to arrange enemy As if tribe be crime As if surname fit fire gun Na magic dem dey do Political jazz Change name Change story Change people destiny If coup loud Make e sound Igbo If wahala burst Point finger for one side So crowd no go ask who steal rice Who drain oil Who turn country to ATM Na old trick Divide so dem fit rule Confuse so dem fit chop Dem dey use uniform cover naked lies I don waka this road before From Kalakuta to court room From radio ban to prison wall Na the same script Different actors Same wicked director Today na Igbo Tomorrow na Yoruba Next tomorrow na poor man with sense Anybody wey ask question become suspect But hear me well Name no dey overthrow government Hunger fit Corruption fit Arrogance fit If dem fear tribe pass truth Then truth don near power Make una no fall for am Make una no dance to wrong drum Na we be Nigeria Not dem If dem change your name for their mouth No change your mind for their sake Area boys and area girls Open eye This film don old And the ending dey bloody Na Charly talk am I no dey whisper truth I shout am For street For mic For history Because one day This country go wake And ask Who really plan am And lie no go fit answer. Make una dey get ready for 999. E go shake una.

Charly Boy Area Fada 1

22,686 次观看 • 7 个月前

When OBJ Kiss CharlyBoy Lately, I don find myself falling for Baba,His Excellency Chief Olusegun Obasanjo. No be play Baba na man of many parts E be like say our relationship don shift enter another level o... The kind level wey dey warm my heart and dey always make Baba smile anytime him sight me. Sometimes I even dey feel say my late papa, wey be Baba old friend, still dey whisper to me through am. If I try explain am well, e fit sound somehow… but deep down, the feeling real. Today I attend Baba birthday celebration. Tables full. People dey laugh. Big men and women dey greet themselves. Correct food dey flow. The whole hall dey bubble with life. Then Baba enter. As Chief Olusegun Obasanjo step inside, the whole atmosphere change. Respect rise for the room. People stand. Glasses lift. Smiles everywhere. The man wey history don write plenty chapters about go sit for the high table like the true elder wey him be. Then my own moment show face. I carry my birthday gift. But I no carry am normal way. I balance am for my head gidigba! Village boy style. Step by step I waka go the high table. No hurry. Just respect. Rhythm. And small drama… the way CharlyBoy sabi. When I reach Baba, I present the gift. Simple moment… but the love, warmth and joy inside am heavy. Next thing wey happen shock even me. Baba plant correct kiss for my gorimakpa. The hall burst laugh. Because sometimes celebration no really be about cake, champagne or long grammar speeches. Sometimes… na about honour. Honour for a life wey don see storms, battles and history yet still stand strong like iroko tree. And today… Abeokuta witness am.

Charly Boy Area Fada 1

65,235 次观看 • 6 个月前