Sensitive content
This media may contain sensitive content.
Video wird geladen...
Video konnte nicht geladen werden
who else is familiar with this scam? 😹😭
384,104 Aufrufe • vor 12 Tagen •via X (Twitter)
63 Kommentare

Even if she be newbie for Lagos Why u go dey engage Agbero for any reason? She just dull naturally

iffa answer them make i bend

Swear down

omo if yunno wise for this lagos, yunno fit wise for anywhere again 😹

This is how I had my pocket picked 😭 Can’t forget 2018 he took my tecno spark k7 😭

omo people are just w!cked

Dem do am for one of my guys then for secondary school em itel wey we dey use play Dream league for class Naso e take go

omo, some people no get joy at all

Na so one guy talk say he wan show me how I go gum palm wey I just buy 😂

exactly their format 😹🤏

Na wetin dem first use comot phone from my pocket b this while I was travelling bk home from viarfinschooloo

viarfinschooloo?

One guy ran me this thing in 2015. He removed the 20k in my pocket. I noticed immediately and grabbed him. He brought it out and said it was about to fall. I counted 19k when he left. Unluckily for him, I saw him the next day and collected all the money on him about 2,500 😂

sharp 😹

Omo I say make I no too harsh as he was so concerned say I go spoil my slides - the slides expensive pass as I dey wear am. Naso I leave am. Werey comot my 20k live. He later pay damages with him 1,500 . The idiot run cross road immediately I start Dey call people the next day 😂

Naso them carry my Nokia C2 when I de ss2 , I de come back from school jeje o 😂, I de waka go house naso I meet the werey “you no wear your sandals well” 😭

😹😹 which year be that

Na you carry the phone ? This one weh you de laugh 🌚 Na like 2012 ish

me keh

Dem do am for my guy that year as the guy Dey comot phone for hin pocket na hin I catch am we beat nonsense commot hin body ehn😂😂

omo thank God una catch am 😹

Naxo they take remove Samsung from my pocket… I was new to it then … you can’t try it with me now

the best thing is just don’t respond to anyone calling you on the street

Yes just pretend deaf

Whats it about?

they’re sc@mmers

I no Dey follow stranger talk

that’s just it

I no care make you don lost or your transport or hotspot or anything do you…. I just know say no be me God send to help

No be cms be that ?

You sabi

That's CMS 😹😹😹😹

you sabi jhoor

Copy and paste exactly what happened to me in 2016 on my way to Unilag for first lectures. As I won climb campus shuttle, I see say my pocket won empty small The guy don even pass side of one parked danfo; as I just crossed to meet baba, he shapaly returned the phone Next time someone else tried it in 2018, when e see say I no dey buy the scam, e tell me say “Oje ni e” in yoruba and left me

I chop knock one day I no go ever forget 😭😂

hanhan why how 😹

The woman no get chills😭

The girl no wise at all 😭

she go soon wise sha

We sabi this style na😂

better 😹

This thing worked on me Baba say he match me make he clean my palms Naso my infinix vanish I waka 2 steps I no see my infinix for my pocket naso I cross road go meet am o One roadside vendor tell me say make i go do thanksgiving 😂

No be life una dey live for Lagos o 😭😂

Not for the weak 😹

this one na new signing for sporting fc

sporting fc?

The first time my phone was pickpocketed, it was this method the thief used. My first week in Mushin, it happened at night 😄

Your bag oh

I remember this is how he picked my phone in my pocket omoh I no fit forget oo and I get one CL on my hangout that time e really broke my heart and I go back to start working in Yale biscuits company 😭 for 3 months to buy new phone.

Dem been do dis shit for me that year for fadeyi, as d boy dey move the phone from my pocket I just dey look am after he finish I just stretch hand make he gimme back my phone, he Kon dey beg, I just leave am dey go my house..

Also

Please what will happen if you remove your shoes

they’ll pick your belongings before you know

Them don use this same style move my phone before But 5 sec after he did it, I just feel say my pocket don light. Naso I tell the guy say "I know say you don carry my phone, just give me" Baba say the phone fall down and ee help me pick am I no argue. I collect am kan move

Naso Dem pick pocket my Xr for Gbagada 2022

Ahh you go dull am

Omo guy, I agree ohh I jus come out from church jae , put phone for pocket say mk I enter bus go oshodi Naso the werey come meet me ohh 😅

Omo in Sango, Ibadan some years ago😹😹

Dem almost use this trick for me when I Dey Bariga , the werey guy stole my phone in the process but I caught him red handed he was now saying it’s a joke I just move after I got my phone back from him 😂😂😂 I think 2017 or 2018 sha

Omo na so dem take carry my phone that year

chai

Eko .. you go wise

Aswear
