Loading video...

Video Failed to Load

Go Home

"Odumodu get show. For 1004, Odumodu friends dey trapped inside elevator. E remain small make those boys die..." - Seun Kuti

344,562 views • 8 months ago •via X (Twitter)

0 Comments

No comments available

Comments from the original post will appear here

Related Videos

Una remember Oputa Panel Dat my papa show wey almost wan dey as popular like The CharlyBoy Show. I be Charly Boy Area fada I don see plenty useless film for this country Na the same cassette dem dey rewind Colonel open mouth Truth close eye Call Yoruba name Igbo Just to repaint fear Just to arrange enemy As if tribe be crime As if surname fit fire gun Na magic dem dey do Political jazz Change name Change story Change people destiny If coup loud Make e sound Igbo If wahala burst Point finger for one side So crowd no go ask who steal rice Who drain oil Who turn country to ATM Na old trick Divide so dem fit rule Confuse so dem fit chop Dem dey use uniform cover naked lies I don waka this road before From Kalakuta to court room From radio ban to prison wall Na the same script Different actors Same wicked director Today na Igbo Tomorrow na Yoruba Next tomorrow na poor man with sense Anybody wey ask question become suspect But hear me well Name no dey overthrow government Hunger fit Corruption fit Arrogance fit If dem fear tribe pass truth Then truth don near power Make una no fall for am Make una no dance to wrong drum Na we be Nigeria Not dem If dem change your name for their mouth No change your mind for their sake Area boys and area girls Open eye This film don old And the ending dey bloody Na Charly talk am I no dey whisper truth I shout am For street For mic For history Because one day This country go wake And ask Who really plan am And lie no go fit answer. Make una dey get ready for 999. E go shake una.

Charly Boy Area Fada 1

22,686 views • 6 months ago

When OBJ Kiss CharlyBoy Lately, I don find myself falling for Baba,His Excellency Chief Olusegun Obasanjo. No be play Baba na man of many parts E be like say our relationship don shift enter another level o... The kind level wey dey warm my heart and dey always make Baba smile anytime him sight me. Sometimes I even dey feel say my late papa, wey be Baba old friend, still dey whisper to me through am. If I try explain am well, e fit sound somehow… but deep down, the feeling real. Today I attend Baba birthday celebration. Tables full. People dey laugh. Big men and women dey greet themselves. Correct food dey flow. The whole hall dey bubble with life. Then Baba enter. As Chief Olusegun Obasanjo step inside, the whole atmosphere change. Respect rise for the room. People stand. Glasses lift. Smiles everywhere. The man wey history don write plenty chapters about go sit for the high table like the true elder wey him be. Then my own moment show face. I carry my birthday gift. But I no carry am normal way. I balance am for my head gidigba! Village boy style. Step by step I waka go the high table. No hurry. Just respect. Rhythm. And small drama… the way CharlyBoy sabi. When I reach Baba, I present the gift. Simple moment… but the love, warmth and joy inside am heavy. Next thing wey happen shock even me. Baba plant correct kiss for my gorimakpa. The hall burst laugh. Because sometimes celebration no really be about cake, champagne or long grammar speeches. Sometimes… na about honour. Honour for a life wey don see storms, battles and history yet still stand strong like iroko tree. And today… Abeokuta witness am.

Charly Boy Area Fada 1

65,235 views • 5 months ago

Sheikh Gumi Come make I ask you something you dey alright? Do u need medical attention? You Dey think before you talk? You say attacking bandits will be a mistake? Are you mad? Are you normal? Or na bandit spirit don colonize your sense? People dey cry, Families dey bury children, Farmers no fit go farm, Villages dey empty like ghost town And you stand for public dey defend criminals wey be your congregation? Wetin dey wrong with you?? Any small thing, you go rush microphone: “Negotiate with them.” “Don’t attack them.” “Give them amnesty.” “Bandits are not terrorists.” Shut up abeg. Which kain amnesty you don ever suggest for the victims? Which kain negotiation you don do with the families wey bandits scatter their future? E clear say na you dey represent killers. You dey talk like their PRO. Like their spiritual adviser. Like their unofficial mouthpiece. I don tire for your nonsense, honestly. You be cleric, but your mouth no dey bring peace. Na fake you be You dey act like say bandits na endangered species wey we suppose protect. God punish you for us. Let me tell you now Any leader, cleric or elder wey dey use “dialogue” excuse to pamper killers is part of the problem. U no go die better I swear. Because if na your family bandits carry, If na your people dem butcher, Your mouth no go ever produce “dialogue.” You go suddenly turn military commander. You go shout “attack them!” louder than siren. Sheikh Gumi, hear me well: Stop talking nonsense. Stop defending evil. Stop creating confusion. Stop making Nigeria look like playground for criminals. For once, use your influence talk truth: “Bandits must be crushed. Victims must be protected. Government must wake up.” If you no fit talk that one, At least respect your old age and shut the fuckup. Ur fathers left nyash. Make una help me rain curses on dis mad man.

Charly Boy Area Fada 1

149,919 views • 9 months ago