Video yükleniyor...

Video Yüklenemedi

Ana Sayfaya Dön

Today, I walk through something wey words no fit fully capture. Standing side by side with Baba Olusegun Obasanjo and my brother Aliko Dangote, I take another look at wetin vision, courage and persistence fit build. This refinery no be small project. E be like city inside city. As...

196,695 görüntüleme • 2 ay önce •via X (Twitter)

0 Yorum

Yorum bulunmuyor

Orijinal gönderinin yorumları burada görünecek

Benzer Videolar

Charlyboy don carry me enter some places wey I no belive say I fit enter in my life. On dis Palm Sunday I followed my oga to go see OBJ. As I sit down in the same room with the Baba today I saw two men. Two generations. One room but plenty history inside. Both of dem going through letters. Invites. Discussing Names wey matter. People wey go show face for the Lunch of 999, The Memoir of charlyboy. Baba pick pen, just dey do correction for the letters and invites. Not as former president, but as elder wey understand structure, timing, weight of things. At one point, I just smile. For me it was the bounding and interactions with two outstanding men. This one no be politics. This na respect. This na belief. Between, Man wey the world don know finish wey put hand for something wey people still dey try understand. Baba, on behalf of charlyboy dey invite people by himself. Not because he needs to but because he believe and he loves the brand. And I dey watch my oga charlyboy like son wey dey learn again from him father. Life funny. One man wey world don know. Another man wey world think say dem know but dem never even scratch surface and when dem join hand like this, you go see something wey no dey regular. This thing wey dey come, no be small. People go enter and come out different. Because sometimes, when experience meet vision, something new dey born. Baba will jokingly call charlyboy a jagrajagre person, charlyboy go clap bk and say, Na u dey teach me. It was a beautiful experience to watch these two men full of respect and admiration for one another.

Charly Boy Area Fada 1

100,923 görüntüleme • 5 ay önce

Shallipopi finally break silence for IG Live after Mavo pleaded for forgiveness and said Shallipopi is his friend. 'Mavo, make we get this one straight. I no be your friend, and I go never be your friend I no fit get friend like you. You just blow, e no reach one year, you don start dey open mouth dey talk anyhow to people wey dey industry before you. The way you dey move, na your own career you dey use your hand d£stroy. You be the biggest f@ol I don see. Make I no lie you. You no fit even m@tch my small brother Famous Pluto for music you never get hit song but you don dey run mouth. Yet you get m!nd dey come for me. You no go ever see me dey disr£spect person wey sabi the game pass me? You no go see am. But na people dey push you from behind, and you dey run mouth for Twitter like pikin. You no get s£nse? You no fit tell the person wey dey use you say 'boss make we slow down, I still get long way'? That person no dey l@se anything. Na you dey put your career for fir£. Even if you dey respect the person wey dey send you tweet because I know na your boss dey put words for your mouth but wetin I wey go make — you still get liv£r call my name? I no need your apology, and I go ever accept am. I no even plan to reply you, but I say make I clear am make everybody hear. You no dey my level. You no sabi book, you no sabi music. You just be small pikin. Br@ke boy. Hung£r dey show for your face. Go hustle better l!fe for yourself instead of dey f!ght people wey God don lift. Because honestly, you dey play with your lif£. I no send you. If you wan try n@nsense, my brothers Dem active. Dem don tell me say dem ready, but I say make I talk am myself first. I don dey hear all the rubb!sh you dey talk, no be today. I don keep quiet too long. But since you carry am come public, make I answer you. I just wan clear you as e take be.
0:56

Sensitive content

Shallipopi finally break silence for IG Live after Mavo pleaded for forgiveness and said Shallipopi is his friend. 'Mavo, make we get this one straight. I no be your friend, and I go never be your friend I no fit get friend like you. You just blow, e no reach one year, you don start dey open mouth dey talk anyhow to people wey dey industry before you. The way you dey move, na your own career you dey use your hand d£stroy. You be the biggest f@ol I don see. Make I no lie you. You no fit even m@tch my small brother Famous Pluto for music you never get hit song but you don dey run mouth. Yet you get m!nd dey come for me. You no go ever see me dey disr£spect person wey sabi the game pass me? You no go see am. But na people dey push you from behind, and you dey run mouth for Twitter like pikin. You no get s£nse? You no fit tell the person wey dey use you say 'boss make we slow down, I still get long way'? That person no dey l@se anything. Na you dey put your career for fir£. Even if you dey respect the person wey dey send you tweet because I know na your boss dey put words for your mouth but wetin I wey go make — you still get liv£r call my name? I no need your apology, and I go ever accept am. I no even plan to reply you, but I say make I clear am make everybody hear. You no dey my level. You no sabi book, you no sabi music. You just be small pikin. Br@ke boy. Hung£r dey show for your face. Go hustle better l!fe for yourself instead of dey f!ght people wey God don lift. Because honestly, you dey play with your lif£. I no send you. If you wan try n@nsense, my brothers Dem active. Dem don tell me say dem ready, but I say make I talk am myself first. I don dey hear all the rubb!sh you dey talk, no be today. I don keep quiet too long. But since you carry am come public, make I answer you. I just wan clear you as e take be.

dangerous baby

326,026 görüntüleme • 4 gün önce

When you mention the kind relationship wey no too common for this country, you go talk about Charly Boy and Olusegun Obasanjo. Many people no understand am at first. How rebel wey dey always challenge government take dey close to former president. But life no be black and white like that. Sometimes na respect and understanding dey build bridge where people no expect. Baba Obasanjo see something inside Charly Boy wey plenty people miss. He see courage. He see consistency. He see man wey stand for him truth whether rain fall or sun shine. And Charly Boy too see beyond uniform and title. He see elder wey don pass through war, leadership, pressure and still stand strong. Their relationship no be noise relationship. Na quiet understanding. When dem talk, na two strong minds wey dey reason Nigeria matter. Dem fit argue, dem fit disagree, but bitterness no dey. Respect dey intact. That respect show clearly when Baba Obasanjo personally host the biggest moment of Charly Boy career, the launch of him life story book 999. That event no just be about selling book. Na honour. Na acknowledgement. Na elder telling younger warrior say I see you. For that day, politics and activism sit down for one table. It prove say bond no dey always about agreeing on everything. Sometimes e just about recognizing value in each other. The fondness between dem real. You fit see am for the way dem dey talk about each other with warmth. No fake protocol vibe. Just genuine regard. For country wey division too much, their connection send message say dialogue possible. Respect possible. Unity possible. And when two strong men choose mutual respect over ego, that one na powerful example.

Charly Boy Area Fada 1

58,698 görüntüleme • 6 ay önce

When OBJ Kiss CharlyBoy Lately, I don find myself falling for Baba,His Excellency Chief Olusegun Obasanjo. No be play Baba na man of many parts E be like say our relationship don shift enter another level o... The kind level wey dey warm my heart and dey always make Baba smile anytime him sight me. Sometimes I even dey feel say my late papa, wey be Baba old friend, still dey whisper to me through am. If I try explain am well, e fit sound somehow… but deep down, the feeling real. Today I attend Baba birthday celebration. Tables full. People dey laugh. Big men and women dey greet themselves. Correct food dey flow. The whole hall dey bubble with life. Then Baba enter. As Chief Olusegun Obasanjo step inside, the whole atmosphere change. Respect rise for the room. People stand. Glasses lift. Smiles everywhere. The man wey history don write plenty chapters about go sit for the high table like the true elder wey him be. Then my own moment show face. I carry my birthday gift. But I no carry am normal way. I balance am for my head gidigba! Village boy style. Step by step I waka go the high table. No hurry. Just respect. Rhythm. And small drama… the way CharlyBoy sabi. When I reach Baba, I present the gift. Simple moment… but the love, warmth and joy inside am heavy. Next thing wey happen shock even me. Baba plant correct kiss for my gorimakpa. The hall burst laugh. Because sometimes celebration no really be about cake, champagne or long grammar speeches. Sometimes… na about honour. Honour for a life wey don see storms, battles and history yet still stand strong like iroko tree. And today… Abeokuta witness am.

Charly Boy Area Fada 1

65,235 görüntüleme • 6 ay önce

Una remember Oputa Panel Dat my papa show wey almost wan dey as popular like The CharlyBoy Show. I be Charly Boy Area fada I don see plenty useless film for this country Na the same cassette dem dey rewind Colonel open mouth Truth close eye Call Yoruba name Igbo Just to repaint fear Just to arrange enemy As if tribe be crime As if surname fit fire gun Na magic dem dey do Political jazz Change name Change story Change people destiny If coup loud Make e sound Igbo If wahala burst Point finger for one side So crowd no go ask who steal rice Who drain oil Who turn country to ATM Na old trick Divide so dem fit rule Confuse so dem fit chop Dem dey use uniform cover naked lies I don waka this road before From Kalakuta to court room From radio ban to prison wall Na the same script Different actors Same wicked director Today na Igbo Tomorrow na Yoruba Next tomorrow na poor man with sense Anybody wey ask question become suspect But hear me well Name no dey overthrow government Hunger fit Corruption fit Arrogance fit If dem fear tribe pass truth Then truth don near power Make una no fall for am Make una no dance to wrong drum Na we be Nigeria Not dem If dem change your name for their mouth No change your mind for their sake Area boys and area girls Open eye This film don old And the ending dey bloody Na Charly talk am I no dey whisper truth I shout am For street For mic For history Because one day This country go wake And ask Who really plan am And lie no go fit answer. Make una dey get ready for 999. E go shake una.

Charly Boy Area Fada 1

22,686 görüntüleme • 6 ay önce

Reno, Come front, I wan talk to U. When I see how far some people fit go, just to wear fake respectability on top rotten shit character, na so dia shame dey shame me.???,., You see, when person come from gutter, no be the gutter be the problem na when the person carry the gutter enter him spirit na dia wahala start. All this gra-gra activism na where belle face you face. You wan use people’s suffering buy political appointment? You dey twist stories of Christian killings, one minute you cry “genocide,”next minute you say “no genocide” all because your stomach don move to another camp. Reno, you be proof say education no equal integrity. Big grammar no fit cover small mind and big shit. See ehn, hypocrisy get smell and your own don reach everybody nose. Fada no go keep quiet. Because silence na how fake men become role models. You no fit build your fame on falsehood and expect to go free. Not in this Nigeria wey young people dey struggle to find truth in the middle of lies. Reno, you owe Nigerians and the Church you claim to defend a big apology. You owe truth itself a confession. Because right now, you look like man wey trade his soul for relevance and that, my brother, is the worst kind of poverty. You fit deceive people for a while, but truth no dey expire. E go wait for you like judgment. This no be fight, this na correction. But if you think say you're bigger than truth remember say even kings fall when lies became their throne. Ur fathers left nyash.

Charly Boy Area Fada 1

31,377 görüntüleme • 10 ay önce

Sheikh Gumi Come make I ask you something you dey alright? Do u need medical attention? You Dey think before you talk? You say attacking bandits will be a mistake? Are you mad? Are you normal? Or na bandit spirit don colonize your sense? People dey cry, Families dey bury children, Farmers no fit go farm, Villages dey empty like ghost town And you stand for public dey defend criminals wey be your congregation? Wetin dey wrong with you?? Any small thing, you go rush microphone: “Negotiate with them.” “Don’t attack them.” “Give them amnesty.” “Bandits are not terrorists.” Shut up abeg. Which kain amnesty you don ever suggest for the victims? Which kain negotiation you don do with the families wey bandits scatter their future? E clear say na you dey represent killers. You dey talk like their PRO. Like their spiritual adviser. Like their unofficial mouthpiece. I don tire for your nonsense, honestly. You be cleric, but your mouth no dey bring peace. Na fake you be You dey act like say bandits na endangered species wey we suppose protect. God punish you for us. Let me tell you now Any leader, cleric or elder wey dey use “dialogue” excuse to pamper killers is part of the problem. U no go die better I swear. Because if na your family bandits carry, If na your people dem butcher, Your mouth no go ever produce “dialogue.” You go suddenly turn military commander. You go shout “attack them!” louder than siren. Sheikh Gumi, hear me well: Stop talking nonsense. Stop defending evil. Stop creating confusion. Stop making Nigeria look like playground for criminals. For once, use your influence talk truth: “Bandits must be crushed. Victims must be protected. Government must wake up.” If you no fit talk that one, At least respect your old age and shut the fuckup. Ur fathers left nyash. Make una help me rain curses on dis mad man.

Charly Boy Area Fada 1

149,947 görüntüleme • 9 ay önce

Erigga live on ig, Davido is true that your dad have money but your noise is too much. The money that can’t buy you Grammy since you’ve been fighting for it look at Wizkid and Burna boy won their own without stress but you’re always here broke shaming and body shaming people instead make you use the opportunity to compose good song with meaningful lyrics and stop looking for a song writer. At least I don’t depend on people to have hit or I depend on them to write for me you puşssy niggaa. You don dey this industry for years, still the same story every time big mouth, small result when it come to that one award you dey chase like say e go drop from sky because of family name. Wizkid and Burna just dey work, drop their music, collect their Grammy without all this extra wahala and online shouting you dey do. You sef prefer to jump on people matter, call them broke, talk their body, drag them for comments instead of sitting down one place and writing something that go actually last. All that money no fit buy you the respect or the award you dey crave, yet you still dey make noise like say noise na the main work. If you put half of that energy into real lyrics instead of looking for who go write for you or who you go shade next, maybe people go take you more serious. Me I no dey wait for anybody to carry my sound or write my words; I stand on my own work. You just dey too loud for somebody wey still dey struggle with the same thing after all these years, you puşssy niggaa. Calm down small and face the music properly.

SoloMon ♨️

108,291 görüntüleme • 1 gün önce