
Charly Boy Area Fada 1
@AreaFada1 • 477,254 subscribers
Founder of the OUR MUMU DON DO organisation, Da AreaFada Odudubariba 1 of Africa. For bookings and adverts: +2348024231487
Shorts
Videos

Well Done my son, Very Dark Man. All you said was nothing but the truth. Very well researched. This is why I don't like the word, "activists" because I know many of dem dey use am as business. VDM, u forget to mention the horrible campaign dey carried out on me. Deji, Sowere and co because I refused to bring the money Ford Foundation gave my Foundation for a campaign. Dey wanted me to bring out the money to share to dem, Sowere was the ring leader. My first encounter with real betrayal. VDM my son, I pray you remain consistent in ur pursuit of a better Nigeria. God bless.
Charly Boy Area Fada 1594,674 просмотров • 3 месяцев назад

Me and my junior brother discussing the 31st of July. The day I go send down the rain.
Charly Boy Area Fada 1172,429 просмотров • 1 месяц назад

Today, I walk through something wey words no fit fully capture. Standing side by side with Baba Olusegun Obasanjo and my brother Aliko Dangote, I take another look at wetin vision, courage and persistence fit build. This refinery no be small project. E be like city inside city. As we dey waka through the massive structures, pipelines and facilities, one thing keep ringing for my head: One man’s dream fit become national asset. People dey always talk about wetin Nigeria no get. Today, I see wetin Nigeria fit become when ambition meet execution. The love from workers and visitors wey stop to take pictures, gist and share moments with us reminded me of something important: People still dey hungry for hope. Not the hope wey politicians dey promise every election season. The hope wey you can touch. The hope wey you can see. The hope wey stand physically before your eyes. As Baba, Dangote and I stood together for photographs, I no just see three men. I see three different journeys. Different paths. Different convictions. But one lesson: Never underestimate wetin one determined human being fit achieve. Nigeria still get challenges. Plenty. But days like this remind me say possibility still dey alive. And sometimes, seeing is believing.
Charly Boy Area Fada 1196,513 просмотров • 1 месяц назад

My people, U can already guess where your Area Fada dey? Olamide Baddo Bus Stop! Yes o, na the same bus stop wey una sabi since… now na Baddo get am. Street na street, e no get age limit, abi? I just dey inside car dey laugh yeye people wey wan show Fada power. The Emperor of Nigeria go soon rename everywhere. Next thing, dem go name airport after one DJ, then call National Assembly ‘Comedy Central’. Yeye dey smell. For me? I still go dey fresh, I still dey cruise, and I still no send anybody wey no like am. Life too short to dey vex for bus stop name change, when I never chop. Dia Father's.
Charly Boy Area Fada 1999,021 просмотров • 11 месяцев назад
2:22
Sensitive content
This media may contain sensitive content.

Sometimes, na the smallest moments dey preach the biggest sermons. Watching Area Fada and Iyabo Obasanjo embrace each other, I no just see two familiar faces. I see two families wey choose relationship over tribe. One from the East. One from the West. Yet, no boundary. No suspicion. No “us” and “them.” Just genuine love and respect. Na this kind Nigeria I dey dream about. A Nigeria where we no first ask, “You be Yoruba?” “You be Igbo?” “You be Hausa?” Before we decide whether to love or trust person. The strongest families no be always the ones connected by blood. Sometimes, na shared values and mutual respect build the deepest bonds. That hug lasted only a few seconds. But the message e carry, fit last generations. Maybe the Nigeria we dey look for no too far. Maybe e begin the day we stop raising our children to inherit tribal walls and start teaching them to inherit humanity. Asanwa
Charly Boy Area Fada 115,998 просмотров • 6 дней назад

“If I Demand N20 Billion every month & even award all the contracts to myself, that's politics. Where was he when I was fighting? I have to be politically relevant & I must maintain my political structure. I can't allow anybody to cut me out immediately” — Wike defends his fight against Gov. Sim Fubara. _The shameless sense of entitlement to public funds, the blatant exhibition of corruption on International media, and the effrontery to dignify corruption is sickening_
Charly Boy Area Fada 11,267,171 просмотров • 2 лет назад

How Pathetic. A lawyer burnt his wig to say good bye to practice. Nigeria Judiciary has slaughtered justice. I bin don know dis demonic outcome since last week, but just waiting to see if dem yeye judges fit pull a stunt. Na now wey we go come know the full meaning of hardship. Brace up.
Charly Boy Area Fada 1753,285 просмотров • 2 лет назад

Kenyan parliamentarians, after running for their lives ended up eating in the bush 🤣🤣🤣. Nigerian youths ooooo This will be benediction for Nigerian APC government, parliamentarians, low and high ministers, Ambassadors, ect ect. Kenya’s current dispensation is Just a friendly “good morning” compared to what’s looming and Awaits the so called giant of them all.
Charly Boy Area Fada 1553,621 просмотров • 2 лет назад

Charlyboy don carry me enter some places wey I no belive say I fit enter in my life. On dis Palm Sunday I followed my oga to go see OBJ. As I sit down in the same room with the Baba today I saw two men. Two generations. One room but plenty history inside. Both of dem going through letters. Invites. Discussing Names wey matter. People wey go show face for the Lunch of 999, The Memoir of charlyboy. Baba pick pen, just dey do correction for the letters and invites. Not as former president, but as elder wey understand structure, timing, weight of things. At one point, I just smile. For me it was the bounding and interactions with two outstanding men. This one no be politics. This na respect. This na belief. Between, Man wey the world don know finish wey put hand for something wey people still dey try understand. Baba, on behalf of charlyboy dey invite people by himself. Not because he needs to but because he believe and he loves the brand. And I dey watch my oga charlyboy like son wey dey learn again from him father. Life funny. One man wey world don know. Another man wey world think say dem know but dem never even scratch surface and when dem join hand like this, you go see something wey no dey regular. This thing wey dey come, no be small. People go enter and come out different. Because sometimes, when experience meet vision, something new dey born. Baba will jokingly call charlyboy a jagrajagre person, charlyboy go clap bk and say, Na u dey teach me. It was a beautiful experience to watch these two men full of respect and admiration for one another.
Charly Boy Area Fada 1100,923 просмотров • 3 месяцев назад